Apple iPhone 12 release date: How iPhones 2G, 3G, iPhones 4, 5, 6, 7, iPhones 6, 8 Plus, iPhone X &

August 2024 · 5 minute read

27 July 2020

Apple iPhone don become one of di world most valuable company in di last 20 years.

Sir Jony Ive, di Briton wey leave Apple for June 2019 na im be di key designer behind the iPhone, iMac and iPod: products wey help make Appledi world most valuable company.

Apple dey plan to release iPhone 12 soon. Now make you look back into di evolution of di handset.

You fit remember how we get to a point wia one iPhone fit cost more than half a million naira or a thousand dollars in di eleven years of existence of dis handset?

How iPhones don change over di years

We don check out di changes - from size and features to di diffrent prices of di iphone.

Di beginning - otherwise known as iPhone 2G

iPhone 2G na di 1st generation iPhone wey dem release in United States, June 2007.

Apple bin put $499 (£381) price tag for di 4GB model and $599 (£457) for the 8GB model.

Dem know am as di iPhone 2G because Apple decided only to make di handset work wit the 2G data network, not di faster 3G.

Now some pipo consider am as collector's item by some - and dem dey sell am on eBay for significantly more than di original retail price.

iPhone 3G

Di iPhone 3G land in July 2008 across 22 different kontris and sell over 1 million units in di first weekend wey di handset open market.

Di second generation phone bin come in two colours - black and white - and e bin dey cheaper at £99 wit a two-year contract.

Di phone came wit iOS 2.0 software and receive a wave of oda updates wey enable features such as multimedia messaging (MMS) and copy and paste.

A year later di iPhone 3GS was land - di S stand for speed - di new slogan being: "Di fastest, smartest phone yet."

Di iPhone 3G stop in June 2010.

iPhone 4

Back in June 2010, di fourth generation iPhone na im dem reveal for Apple's Worldwide Developers Conference in San Francisco,

CEO Steve Jobs call di iPhone 4 di thinnest smartphone in di world at di time.

"Dis one change evritin. Again," na di slogan dis time.

Di phones newly introduced front-facing camera give Apple an edge on oda smartphone competitors - as e mean e now get FaceTime video chat.

Di 16GB model would go cost you £499 dat time, and di 32GB version £599.

Di fifth generation device, di iPhone 4S dem release am just over a year later - wey introduce voice-assistant Siri for di very first time in October 2011.

iPhone 5

Di iPhone 5 na for September 2012 dem release am and e be di last Apple device wey Steve Jobs supervise - he come die di year before in 2011.

Wen Apple bin begin take pre-orders dem receive over two million orders in 24 hours.

Di hanset new features include being 4G enabled, being thinner, lighter and e get taller secreensthan di former models.

Di iPhone 5 price dem bin put am for at £529 (16GB), £599 (32G) and £699 (64GB).

Di announcement of di iPhone 5C and 5S in 2013 signify Apple dey discontinue di original iPhone 5.

iPhone 6

Di releae of di iPhone 6 and 6 Plus in September 2014 bin see Apple introduce a plus-size option.

Di 6 and 6 Plus show 4.7 and 5.5 inch displays in dat order

E come wit camera upgrade, increased battery life and di introduction of Apple Pay as part of some of di many features of di new device.

Di iPhone 6 price bin stand at £539, sim-free.

Di iPhone 6 and 6 Plus na Apple flagship phones for just under a year until dem replace dem wit di iPhone 6S and 6S Plus.

iPhone 7

Di iPhone 7 bin dey released in September 2016 - di handset starting price in di UK na£549.

For £669 you go get di iPhone 7 Plus.

Both models came in either 32GB or 128GB sizes and bin dey available in a range of colours - grey, black and red.

Dis generation of iPhone see di headphone jack removed, di addition of water-resistant technology and one new and improved 12 mega-pixel camera.

iPhone 8, 8 Plus and X

Di iPhone 8, 8 Plus and X na im dem announce in September 2017 at di Steve Jobs Theater for Apple's headquarters inside California, US.

Di iPhone 8 and 8 Plus dem release later say September and dem dey available in silver, space grey and a new gold colour.

Instead of di aluminium casing featured in di iPhone 7, Apple bin move sharperly to one all-glass design for di iPhone 8 and 8 Plus.

Prices start at £699 for di 64GB iPhone 8 and £799 for di 64Gb version of di iPhone 8 Plus.

As for di iPhone X - dem release am in November 2017, marking di tenth anniversary of the iPhone.

E feature di removal of di home button, one OLED display on a 5.8 inch screen and wireless charging.

Di handset new and improved features mean say di anniversary phone price dey just under di one thousand pound mark - at £999.

Since then...

Apple don release three more phones.

iPhone XR, iPhone XS and XS Max.

E go cost you £749 to buy di cheapest of di three and a whopping £1,449 to buy di most expensive.

But those prices fit all change afta Apple boss Tim Cook hint say di firm fit reduce dia iPhone prices in di future - wen, wia, by how much? We no know yet.

And any change in price fit bring a change in look now ? Apple's next iPhone announcements fit be di most interesting yet.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmsKeiobFugZJubG9qYGk%3D